D rat no die
say e no hustle.
E die say e trust.

Trust say free thing
no get backup plan.

Trust say person
wey bring food
no fit bring rope.

Election dey near,
every trap go glow.

Rice go wear
party colour, five-k
go toast your PVC.

Music go loud
pass memory.
OGA wife go fry akara for road.

Power’fool people
go reach your doormouth,
snap picture, shout “my people!”

Dem go call am inclusion.
Dem go call am empowerment.
Dem go call you “my friend”.
Dem go tell you, na their turn.

Dem go wear babariga
enter church, tell you say
una be one.

Dem go break kola
for East, tell you say
una be brothers.

But ask dem where
dem been dey wey NEPA
turn darkness to policy
and house rent climb rooftop.

Ask dem where dem
been dey wey bad road
dey kpai people and bandit turn tax collectors.

Ask dem why their daughter
dey school abroad, and convoy
dey follow their son.

Ask dem, why ‘prayers’
no enter your own inbox.

Hunger dey rush decision.
Suffering dey dull sense.
Empty belle no dey check record.

But real ‘change’
and genuine ‘hope, renewed’
no dey come with giveaway.

E no dey expire after election.
E no dey fear question.

—Amami H.
January 10, 2026
Ojodu, Lagos


KÜNYE ONLİNE sitesinden daha fazla şey keşfedin

Son gönderilerin e-postanıza gönderilmesi için abone olun.

Bir yanıt yazın

KÜNYE ONLİNE sitesinden daha fazla şey keşfedin

Okumaya devam etmek ve tüm arşive erişim kazanmak için hemen abone olun.

Okumaya Devam Edin